Joe Jayi — ”Success” The EP

12
Aug 25

JOE JAYI DROPS HOT 7 TRACKS EP — THIS ONE NA VIBES ON VIBES

If you never hear of Joe Jayi before, abeg make you no dull yourself. This young and amazing artiste from Nasarawa State, Nigeria don finally bless our ears with a brand-new 7 track EP titled “SUCCESS” wey go make you put your playlist on repeat. The melodies sweet, the vibes clean, and the energy no be for here.

Joe Jayi no just dey sing, he dey pour him heart inside every song. From the first track to the last, you go feel say this guy na real talent wey the music industry no fit ignore.

As if that no sweet enough, Joe Jayi carry another Nasarawa born multi-talent WiNA (formerly known as Yizwasi) join body for one track titled “Problem”.

My people, no be small thing as WiNA scatter the verse with him smooth delivery. That collaboration alone fit make you shout “God abeg, repeat am again!”

This EP na proof say good music still dey and fresh talents still dey rise. So, no just sit down dey hear gist download am, listen well, and share the vibe with your people.

1. “This Year”

Download

2. “Hold My Hands

Download

3. “Do Well”

Download

4. “Superstar”

Download

5. “Energy”

Download

6. “I Love You”

Download

7. “Problem” Ft. WiNA

Download

Downloaded Full EP (zip file) below

CLICK HERE

Click any of the icons to share this post: